You no be the girl
Way I be know,
You be shadow of yourself.
I dey look you,
But I no dey see you.
You way be my mamiwata oh!
You way I don sabi before now.
If things wan do me now,
Who go be my mamiwata?
Una don see loml mamiwata,
Abi na papiwata?
Las las;
Dem don leave me
Make I drown for water.
